У нас вы можете посмотреть бесплатно Sex Education или скачать в максимальном доступном качестве, видео которое было загружено на ютуб. Для загрузки выберите вариант из формы ниже:
Если кнопки скачивания не
загрузились
НАЖМИТЕ ЗДЕСЬ или обновите страницу
Если возникают проблемы со скачиванием видео, пожалуйста напишите в поддержку по адресу внизу
страницы.
Спасибо за использование сервиса ClipSaver.ru
Sex na one subject wey many people dey shy from And na the real deal wey some of us for learn from Church and Mosque suppose dey preach am Society sef suppose dey teach am Parents suppose take Sex Education serious Government sef suppose make Sex Education compulsory for our school system Sex na one of those things wey dey destroy our system Make we take chil pill reason this matter from this point of view Maybe when I drop my lines, you go fit do your own review I believe say Sex na for matured adult wey be husband and wife No be for teenagers or young adults wey dem think say dem dey live life See Sex dey beyond our human understanding And na something wey we no go fit comprehend God na him create Sex And him create am for special purpose But we human turn am upside down to suit our evil purpose Sex na physical activities wey dey lead to spiritual connection The result na soul tieing and spirits manipulation How many of us don get spirit husbands and wives from wetin society call social sex We dey possessed with different spirit from sex wey dey make all of us dey vex Many marriages get problems today because of different spirit wey posses everybody from wetin Oyinbo call promiscuity Day don break everybody eyes don open to reality You wey dey sleep with random women and you wey dey sleep with different men, make you ready for spirits battle when you finally marry because Your wife husband's spirit go fight you and your own wives spirits go trouble your wife Na the real fact I dey talk no be lie Bible sef take am say, anybody wey sleep with Ashawo, him and that Ashawo don become one spirit like husband and wife So make you think am before you sleep with that girl or that man And abeg make you ask yourself if you dey ready to open another door for the spirit of Lust, Depression and backwardness And dis talk so ba Na chapter one