У нас вы можете посмотреть бесплатно CHEF, Hilda Baci makes history again after making the biggest pot of Jollof Rice | Festival или скачать в максимальном доступном качестве, видео которое было загружено на ютуб. Для загрузки выберите вариант из формы ниже:
Если кнопки скачивания не
загрузились
НАЖМИТЕ ЗДЕСЬ или обновите страницу
Если возникают проблемы со скачиванием видео, пожалуйста напишите в поддержку по адресу внизу
страницы.
Спасибо за использование сервиса ClipSaver.ru
#HildaBaci #jollofrice #jollofricerecipe #gino Hilda Baci attempt to make world biggest pot of jollof rice Thousands of Nigerians gada for Lagos state Nigeria to watch as former Guinness World Record holder and food influencer Hilda Baci, cook di biggest ever pot of jollof rice in di world, one food wey dey popular for di West African kontri. Di 28-year-old wey gain global recognition for 2023 for breaking Guinness World Record for di longest cooking marathon, (individual), wit a time of 93 hours 11 minutes tell BBC News Pidgin say di reason why she dey attempt to make di record na bicos Naija no dey carry last. "Na we be di giant of Africa, and jollof na food wey everybody sabi Africans for. I come tink am say as di giant of Africa and say our jollof mad, e go make sense if we get di biggest pot of jollof rice, e go dey nice for di kontri." Dis na di first time pesin go try to cook di largest ever pot of jollof. As hashtag #Hilda Baci and #Guiness World Record dey trend for social media, crowds, especially di Gen Z's, millennials, food lovers, vendors and celebrities gada for di venue to show dia support for Baci. Pipo gada some pipo stand, oda pipo siddon for floor to watch Nigerian chef Hilda Baci cook di biggest pot of jollof 'How to make di biggest pot of jollof rice' Hilda Baci tell BBC News Pidgin say e take about one year to come up wit ideas and plan how di cooking go take waka. She say to produce di pot alone take two months. "E take us two months to make di pot wey we go use cook di biggest pot of jollof for di world and na locally made". She reveal say di giant custom-made pot get capacity of 22,619 litres. She add say plenty pipo come togeda to create dis magic. "Di culinary team pass 300". Baci give estimate of di ingredients she go use cook di jollof rice as: 4,000 kg of rice - 200 bags of rice Ova 1200kg of tomato paste – 500 cartons of tomato paste Lots of seasoning cubes Onions 600kg Water 6000 kg Goat meat 168kg Oil 700kg For 2023, Guiness World Record crown di Nigerian chef Hilda Baci as she break di record for di longest longest cooking marathon, (individual), wit a time of 93 hours 11 minutes. She become national sensation afta she cook for four days. Her attempt bin captivate di kontri as politicians and celebrities stop to hail her. "Hilda cook-a-thon in fact dey so popular so tey our website crash for two days sake of di heavy traffic we receive from her legion of loyal fans," GWR bin tok. Hilda bin cook for 100 hours - and she dey allowed five-minute break each hour or di equivalent ova several hours. However, GWR bin log her record at 93 hours 11 minutes, sake of say she take longer break pass di one dem allow for one one occasion. She still beat di previous record by more dan five hours wey one Indian chef Lata Tondon set for 2019. Afta her marathon cooking session, she tok about wetin motivate her: "I just reason say I gatz do sometin… out of di ordinary to put myself on di map, to put Nigeria on di map, to put young African women on di map." "I also decide to break dis record to truly push my limits and test my abilities," she add. Afta she graduate from Madonna University, Nigeria, wit degree in sociology, Baci bin decide to start her culinary career. She dey inspired by her mother, Lynda Ndukwe, wey also be chef. Baci bin host one television show Dine on a Budget for 2020. She win di Jollof Face-off competition for 2021. Representing her native Nigeria, Baci beat Ghana Leslie Kumordzie to claim di victory.